Thursday, July 21, 2011

Una dey madt abi

Wetin dey do una naija people sef,e be like say una don dey madt,una
no dey see as our country dey fuckup abi, una don dey too fear I
beg,any small thing una go talk say una no wan die,una no wan
suffer,na wa o,as tuface talk "nobody wan die but they wan go heaven".
Na long thing una dey do.na wa o

Me I ready carry placard enter road o,this government gats dey collect
steady for our hand, but una dey form butter. Na wa o

Na untill this country fall finish na him una go soji abi,untill Boko
Haram don bomb the whole nigeria finish, I dey talk my own now,una dey
form say una no dey hear me. Na so fela talk am wey una no hear.
Funny, na since 1977 na him fela don talk am but una no wan hear.

See e,this people for govt don build estate on top our head o, na we
money dem dey use jaye.Police sef go dey beat boyz as if say na dem
pay person school fees, sojo sef go dey waka as if say na him get the
whole world.

I no know as una dey take reason am o,but I no go lie,me I don tire,
na y I jus dey talk all my frustration for here so.

I dey take God dey beg una,make una stop to dey fall my hand. If we no
fight for our rights,na who go fight na,una think say Bros J go cum
from heaven cum carry placard for road abi or u think say him go cum
help una sweep una parlour. I beg make we soji o.

Me I don talk my own sha,if una ready fight,make una go join NIGERIAN
YOUTH DEVELOPMENT INITIATIVE for facebook.

Make una no vex as I take talk o,na jus say I dey para for where I dey.

Anyhow sha,we go still dey yarn... Safe

No comments:

Post a Comment